Dem say Boko Haram don poison beans after I buy half bag for house. From the one wey I cook, I give my
dog, Bingo, make im first test am. 45mins later, bingo still dey waka, dey jolly. Na im I come chop my own. After I don chop finish, my gateman run come tel me say bingo don die, hey! I run enter house, begin drink full gallon of palm oil for my belle, chop 22 bitter kola wit 3 long bitter leaf stem, chop walnuts with the shell no time to crack, swallow moringa with aloe vera as treatment combo. Garlic and onions be like sweet for my mouth. I come dey sweat as if na oven be my bedroom. I dey think say my life don finish. I come outside. Na im gate
man com they tell me say the driver wey kill bingo wan come beg me!😀😀😀

If na u, wetin u go do the gate man? ????
Pls don’t laugh alone. For you will never be lonely all this new month of March. You will be surrounded by well wishers who will join to celebrate and rejoice with us. It’s your month of overflowing mercy, grace, favour, goodness, blessings, unending joy and laughter. Happy new month to all.

Leave a Reply Cancel reply

Exit mobile version